Everywhere
for Naija
Na
wahala.
For
right
Na
wahala.
For
left
Na
wahala.
For
centre sef
Na
wahala.
Wahala
full Naija.
If
e no be “Igbo Presidency”,
E
go be “Yoruba autonomy”.
If
e no be “Ogoni self-government”,
E
go be “Ijaw republic”.
If
e no be “Boko Haram insurgents”,
E
go be “former Niger Delta militants”.
If
e no be “cashless economy”,
E
go be “five thousand naira note”.
If
e no be “subsidy scam”,
E
go be “Bakassi”.
If
e no be dis,
E
go be dat.
Wahala
full Naija.
Even
inside di Villa,
Wahala
don enter.
Madam
di madam
Dey
for yonder
Dey
take treatment
For
belle bite.
Wahala
full Naija.
Hello. I'm a student who is planning on looking at poems in pidgin and how they target a specific audience for my English orals. I really enjoyed your poem Wahala Full Naija. I'm a Ghanaian so I understand what most of it means, however I study at an international school in Norway and I was wondering if you could translate the last stanza for me as I have to explain the meaning during my presentation. Your poems are really great and thanks in advance for your help.
ReplyDeleteCecilia,
ReplyDelete"Villa" means Presidential Villa. "Madam di Madam" means First Lady. "Yonder" means outside Nigeria and "belle bite" means stomach pain, Good luck.
hi! Im almost dead laughing. You hav d best pidgin poem ever. I love it and if you dont mind I will post it in naijapoets.com and create a link back to your site. Great post
ReplyDeleteMai broda, abi you bi sista? You fit post am anywhere but remember di credit and di link as you talk.
Delete