Tuesday 10 July 2012

Another "Wey My Own" Wahala For Abuja

Another wuru wuru don show face for Abuja,
Another wahala don burst for Abuja,
Another “wey my own”
Don cause another kata kata for Abuja.
 
One madam like dat dey for Abuja,
Na she be di big madam
For one place like dat
Where dem dey exchange money,
Money dey for di place well well.
 
One house of represent member
Come dey go see di madam,
Come dey ask am,
Madam wey my own?
Madam come dey give,
Come dey settle
Sotee
She come tire to roja.
 
Madam no come dey give again,
House of represent member
Come dey vex.
Di man come arrange
One kin torchlighting like dat.
Di torchlighting na to torchlight
How big madam take chop money.
 
As di torchlighting dey waka,
Yawa come dey gas.
Wuru wuru come dey show face,
Kata kata come,
Wahala burst.
 
E come be say di torchlighting
Na because of "wey my own”
Wey full for Abuja.
 

No comments:

Post a Comment