Tuesday 10 July 2012

Baba Third Term Go Senegal

Baba third term
Don show for Senegal
To settle demo wahala.
As baba don enter Senegal
Na now Senegal people
Go see demo mago mago.

For Naija
Baba don show
As Presido far back,
Dat time
Na khaki im wear.
But fear full im belle,
Im come take hurry hurry
Arrange one mago mago demo,
Come run comot,
Come comot khaki too.

No do, no do
Baba enter prison.
From prison
Baba enter Presido,
Dat one na demo Presido.

Baba Presido time come finish,
But baba no belleful.
Na im baba
Come arrange wayo third term,
Baba name come become
Baba third term.
But di third term no work,
Baba come waka.

Now
Dem don send
Baba third term go Senegal
To go settle demo wahala.
Dat one na to send mad person
To go cure mad people.

No comments:

Post a Comment