Friday 14 September 2012

Probe Me, I Video You


For Naija,
Probe na im be di work,
Di main di main work
Wey politician dem dey work.

Presido people
Dey probe legislate people,
Legislate people
Dey probe Presido people.
Presido people,
Legislate people
Dey join hand probe court people.

Naija
Na so so probe probe,
No action.
Sotay four years go pass,
Dem go meet voter dem again,
Dem go get another four years,
Probe probe go start again.

Dem don carry probe
Enter another level.
Probe me,
I video you
Na im dey now.
As one group
Dey probe another group,
Di group
Wey dat group dey probe
Dey video
Dat group wey dey probe dem.

As probe report dey show,
Video film dey show too.
Argument go full ground,
Probe report go die.

No comments:

Post a Comment