Tuesday 10 July 2012

Africa Crazy Demo Dance

I dream dream last night
Where baba Wade
Take wayo win di run off demo.
 
As baba Wade win,
Im come dey demonstrate,
Dey dance Africa crazy demo dance.
 
I come see baba third term.
Baba third term
Come join baba Wade.
Come see as di two baba
Dey dance Africa crazy demo dance.
 
Baba third term
Come beckon baba Wade.
Di tall baba come bend down,
Baba third term
Come whisper for im ear say;
“No mind di two years
Wey we agree before.
When di time reach
I go tell you wetin to do”.
 
Baba Wade
Look baba third term for face,
Laugh come full
Di two baba dem mouth,
Dem continue to dance
Africa crazy demo dance.

No comments:

Post a Comment