Tuesday 10 July 2012

Rescue Naija Money For Yonder

Swagger
Been full remain,
Demonstration
Come dey over plenty.
Morale over build,
Come see shakara for Sokoto.
 
Dat day,
Come see di people
Wey dem dey call trooper
As dem dey patrol.
 
We hear say
Dem come for rescue,
We hear say
Dem wan rescue two people
Wey kidnapper dem kidnap.
 
Demonstration
Come pass action,
Di rescue come fail.
Accuse
Come dey climb up,
Dey climb down.
 
Now
Wey di rescue don fail,
Make di trooper dem go yonder
Go rescue Naija money
Wey Naija thieficians kidnap
Carry go keep for yonder.
 
Naija people,
We dey,
Dey wait.

No comments:

Post a Comment