Tuesday 10 July 2012

Dis Good Luck Wahala

I remember
Dat time for Naija
Wey be say
Everything we dey talk
Na good luck.
 
Musician dem
Dat time na good luck.
Write write people dem
Dat time na good luck.
Farmer  dem
Dat time na good luck.
Fisher dem
Dat time na good luck.
Even trader dem
Dat time na good luck.
I remember
How we take enter
Dis good luck wahala.
 
Now
Good luck don waka,
Bad luck don enter.
 
I remember
Dat time for Naija
Wey be say     
Everything we dey talk
Na good luck.
I remember
How we take enter
Dis good luck wahala.

No comments:

Post a Comment