Tuesday 10 July 2012

“Wey Our Own”

Bomblast dey here,
Dynamite dey here,
Sinner dey here,
Thunderbolt sef dey here,
Me too
Wey be Morale
I dey here,
All of us dey here for Abuja.

Nobody invite us come,
Na our own national cake
Na im we find come.

Di thug work
Wey we do for dem
For di last election
Dem no pay us,
Na so so “transformation” grammar
Na im we dey hear everyday.
As dem dey nack di grammar,
Na so dem dey wack di national cake,
Dem say make we wait for “transformation”,
Di “transformation” sef
We no see,
We no wait again.

Dem don come Abuja again
To come prepare for another election.
All of us dey here,
Na our own national cake
Na im we find come.

Oya,
Everybody put mouth
Make we talk am together;
Wey our own?
Wey our own?
Wey our own?

No comments:

Post a Comment